Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Acts 4:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Dem dey vex, bikos Pita and John dey tish di pipol sey, na only thru Jesus Christ, pipol go fit wake-up from deat.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Acts 4:2
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So some wise men wey dey learn Epikurean and Stoik kon dey tok with am and some sey, “Wetin dis mumu and toku-toku tink sey e know wey e won tell us?” Some still sey, “E bi like sey e dey prish about some gods from anoda tribe.” (Dem tok so, bikos e dey prish di Good News about Jesus Christ and en resureshon.)


If God Spirit wey raiz Jesus Christ from deat dey inside una, den en wey raiz Christ from deat, go give una body life, bikos of en Spirit wey dey inside una.


But wen di Jew pipol si as di pipol plenty rish, jealousy kon full dia mind, so dem start to oppoz wetin Paul dey tok kon dey curse am.


But all of us must wait for awa turn. Na Christ God first raiz kom life and Christ go raiz en pipol wen e kom back.


sey Christ sofa and e go bi di first to raiz from deat, so dat e go show di lite to awa pipol and even Gentile pipol.”


Why una tink sey God nor fit raiz pipol wey don die?


bikos if e pass dis one, I go shaut as I stand for dia front sey, ‘Una dey judge mi today, bikos I bilive sey pipol wey don die, go wake-up.’ ”


Dat time sirious wahala happen bikos of “Christ Way” wey dem dey prish.


But jealousy kon full di High Priest and di Sadusi pipol mind,


Una kill di pesin wey dey give pipol life, but God raiz am from deat and wi bear witness sey dis na true.


But wen Sanballat, wey kom from Bet-Horon town and Tobaya, one offisa for Ammon aria, hear sey somebody don kom help Israel pipol, dem kon dey vex well-well.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka