10 and dem remember en face kon sey, dis na di man wey dey sidan for di temple door-mot dey beg money, before. Di pipol sopraiz well-well, bikos of wetin happen.
Some pipol dey always karry one man, wey nor fit waka since en mama born am, kom di temple door-mot wey dem dey koll, “Beautiful Gate”, so dat e go dey beg for money from pipol, wey dey enter inside di temple.
Jesus ansa dem, “Nor bi di man or en papa and mama sin, but e blind since dem born am, bikos God won use dis one show en pawa with wetin go happen to am.
Bikos di Papa get strong love for en pikin, e dey always show am evritin wey e dey do and e go show am plenty tins wey pass dis one and una go sopraiz.