Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Acts 3:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 One day, Pita and John dey go di temple go pray for three oklok for aftanoon.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Acts 3:1
27 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

For morning, aftanoon and nite, I dey kry with pain and God hear my vois.


One day, around three oklok for aftanoon, e si vishon where God angel for koll am, “Kornelius.”


Di oga dem sopraiz wen dem si how Pita and John take tok even doh dem nor go skool. So dem kon know sey dis na di pipol wey don follow Jesus Christ waka.


Wen di time to burn incense don rish, all di pipol kon gada for outside dey pray.


Na dat time one pesin kon tell dem sey, “Si o-o, di men wey una put for prison dey for di temple varanda dey tish pipol!”


and dem dey go di temple evritime, dey praiz God.


Wen di apostles wey dey Jerusalem hear sey Samaria pipol don receive God word, dem kon send Pita and John go meet dem,


Wen Daniel hear wetin happen, e kon go en house. E klimb go one room for up wey en window face Jerusalem. Just as e dey do before, e knee down for di window wey open kom pray give God and e dey do am three times evriday.


Dem dey stay togeda evriday like one big family. Dem dey gada go di temple togeda and dem dey go from house to house, dey chop togeda with happiness.


Den, John, di disciple wey Jesus love kon tell Pita, “Dis man na Jesus o-o.” Wen Simon Pita hear sey di man na Jesus, e kon kwik-kwik tie en klot well (bikos e nor wear anytin under), den e jump inside di river.


Jesus tell Pita and John, “Make una go prepare di Passova food wey wi go chop.”


E take Pita, James and John, wey bi Zebedee two shidren, with am. But bikos of wetin won happen, belle nor sweet am.


Afta six days, Jesus take Pita, James and John (wey bi James broda), go on-top one high mountin.


Angel Gabriel wey I don first si for my vishon before kon dey fly kom where I dey. Dat time, dem won offa di evening sakrifice.


Kornelius ansa, “For days ago, for dis kind time for aftanoon, as I dey pray for my house, one man wey en dress dey shine kon stand for my front.


Wen time rish to do di evening ofrin, Profet Elijah waka go di altar go pray, “My Oga God wey bi Abraham, Isaak and Israel God! Make Yu show today sey, na Yu bi Israel God and I bi yor savant wey dey do di tins wey Yu kommand.


Yu go prepare one among di lamb for morning and di sekond lamb, for evening.


so wen James, Pita and John wey bi leaders for di church, si sey God give mi grace, dem kon dey support mi and Banabas sey, “Make wi dey prish give Gentile pipol and doz wey dem sekonsaiz.”


Make una give di first lamb for morning and di sekond one for evening,


E kon happen sey, from twelf go rish three oklok for aftanoon, darkness kon kover di whole land.


“Two men go inside Temple go pray. One na Farisee and di oda one na tax kollector.


As di man si Pita and John wen dem won enter di temple, e kon dey beg dem for money,


but dem look am strait for eye kon sey, “Make yu look us!”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka