Instead, dem dey argue matter with am, about how dem dey serve God and one man wey dem dey koll Jesus Christ wey don die, wey Paul sey e still dey alive.
Den wen Paul know sey some pipol wey dey der na Sadusi and odas na Farisees, e kon shaut make di whole kansol hear, “My brodas, I bi Farisee, na Farisee pesin born mi. Dem dey judge mi today, bikos I put hope sey pipol wey don die go wake again!”