3 So Paul tell am, “God go slap yu too, yu wey dey pritend! Yu sidan dey judge mi with di law, yu nor dey disobey di law wen yu sey make dem slap mi?”
“Awa law nor dey kondemn pesin unless wi don hear wetin di pesin tok or si wetin e dey do, abi nor bi so?”
Israel pipol dey turn bitter judgement to bad one, dem dey trowey wetin dey good and korrect for groun!
I still si sey, for dis world, yu go si wikedness for where good judgement and rite pipol suppose dey.
Wiked leaders go fit sey God dey dia side? Leaders wey dey use di laws take opress pipol!
Make una nor play wayo wen una dey measure how sometin long and wide rish or oda tins wey many.
“ ‘Make una dey honest and pure wen ever una dey judge any matter. And make una nor dey trit poor pipol matter anyhow kon dey show good face to pipol wey get money.
Den Annas kon send am as dem still tie am with rope, go meet Kaiafas, wey bi di High Priest.
Den Profet Zedekaya wey bi Kenaana pikin, waka kom meet and slap Mikaya, den e ask am, “Since wen God Spirit leave mi kon dey tok to yu?”
Di pipol wey stand near am kon sey, “Yu dey curse God High Priest?”