Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Acts 16:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Paul kon still go Derbe and Lystra. One disciple wey dem dey koll Timoti dey der. En mama na Jew wey bilive Christ, but en papa, na Greek.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Acts 16:1
29 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I always dey remember di faith wey yu first get from yor grand-mama, Lois and from yor mama, Eunice. I dey sure sey e dey inside yu.


To Timoti, my pikin wey I love. Make grace, mesi and peace dey with yu from God awa Papa and awa Oga God Jesus Christ.


To Timoti, my own pikin for di faith. Make favor, mesi and peace wey dey kom from God awa papa and Jesus Christ awa Oga God, dey with yu.


So wi kon send Timoti, awa broda wey dey follow us do God work sey, make e kom enkourage una koncerning una faith,


Na to enkourage una make mi send Timoti, my son wey I like and wey love Christ kom meet una. E go tell una how I dey follow Christ and di tins wey I dey prish about Christ for evry church.


Wen Silas and Timoti kom from Masidonia, Paul kon use all en mind dey prish di word, dey tok to Jew pipol sey, na Jesus bi di Christ.


Naim di brodas send Paul go di wotaside, but Silas and Timoti still stay for Berea.


Na Paul, Silas and Timoti rite dis leta go give God and Jesus Christ pipol wey dey di church for Tesalonika.


Dis leta na from mi Paul, Jesus Christ apostle and Timoti my broda, bikos na so God wont am.


As Jesus Christ wont am, I go send Timoti kom meet una, so dat my heart go strong small, with di news wey I go hear about una.


Timoti, my ko-worker; Lucius, Jason and Sosipater my kountry man, all of dem dey greet una.


but wen Paul and Banabas know about am, dem kon run go Lystra and Derbe wey dey for Lykaonia and all di aria wey dey near der


Make una know sey dem don release awa broda Timoti from prison. If e kwik kom, e go follow mi kom si una.


Timoti my pikin, na as dem tok for di words wey dem profesai about yu before, na-im make mi give yu dis kommand. So make dis words make yu strong as yu dey fight for Christ.


Na Paul, Silas and Timoti rite dis leta go give God and Jesus Christ pipol wey dey di church for Tesalonika. Make God grace and peace dey with una.


Dis leta na from Paul and Timoti, wey bi Jesus Christ savant. To all God pipol for Filippi, with dia bishops and leaders.


So, afta e send two men wey dey help am, Timoti and Erastus go Masidonia, e kon still stay Asia small.


Yu know di wahala and sofa wey happen to mi for Antiok, Ikonium and for Lystra. I bear all dis wahala and Christ save mi from dem.


But naw, Timoti don kom meet us afta e si una and e tell us di Good News about di faith and love wey una get. E still tell us sey, una dey always remember and dey hongry to si us, just as wi dey hongry to si una.


Bikos God Pikin, Jesus Christ, di One wey mi, Silas and Timoti dey prish give una, nor bi “Yes” and “No.” But from biginnin, na Jesus bi God “Yes.”


Paul, wey bi Jesus Christ apostle, bikos na so God wont am, naim and Timoti awa broda, rite dis leta go give God pipol for di church wey dey Korint and to all di good brodas for Akaia.


Bikos di husband wey nor bilive, God go save am, bikos of en wife wey bilive and di wife wey nor bilive, God go save am, bikos of en husband wey bilive.


Afta dem don prish God word for dat town and many pipol don turn from sin kom meet God, dem kon go back to Lystra, Ikonium and Antiok.


For Ikonium, Paul and Banabas go inside di Jew sinagog and dem prish sotey many Jew and Greek pipol kon bilive God word.


Jew men dey marry wimen wey bi strenjas, so dem don dirty God pipol wey dey holy and na di leaders and ofisas dey do dis tins pass.


Wen Timoti kom, make una nor make am fear at-all, bikos na God work wey I dey do, naim e dey do too.


Na Paul wey bi prisona bikos of Jesus Christ and awa broda Timoti rite dis leta to Filemon, awa dear broda and ko-worker.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka