9 But Saul (wey dem dey koll Paul) wey get di Holy Spirit, look Elymas for face
But na God pawa and spirit dey my body. E give mi sense to judge well with strent to take tell Israel pipol about dia sin.
Pita wey di Holy Spirit dey use well-well kon ansa, “Awa rulers and eldas,
Den di Holy Spirit enter dia body and as di Spirit give dem pawa, dem kon start to tok for difren language.
But Stefen, wey God dey use well-well, look strait go heaven kon si God glory and Jesus Christ wey stand for God rite hand.
So Jesus vex kon look dem round, bikos dia heart strong well-well, den e tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon well again.
Wen dem pray finish, di place wey dem gada put kon dey shake. Di Holy Spirit enter all of dem and dem kon dey prish God Word with pawa.
But Jesus look dem for face kon ask, “Wetin God word mean wen e sey: “ ‘Di stone wey di builders rijet, don turn to di main stone?’
Nor bi una go dey tok, but na una Papa Spirit go dey tok thru una.
Jesus tosh di man eye again. Di man eye kon open and e kon dey si well-well.