Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Acts 13:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Afta dem don fast and pray finish, dem pray for Banabas and Saul kon send dem go.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Acts 13:3
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Dem show dem to di apostles. Di apostles put hand for dia head kon pray for dem.


Di tins wey yu hear mi tok for pipol present, make yu tish oda pipol wey yu trust sey dem dey ready to tish odas.


Nor stop to dey use di spiritual gift wey yu get; bikos yu get am thru profesy, wen eldas put hand for yor head dey pray.


As dem dey fast and woship God, di Holy Spirit kon tell dem, “Make una separate Banabas and Saul for di work wey I wont make dem do.”


So wi suppose to help doz pipol, so dat wi go bi dia ko-worker wey go make di trut stand.


Make yu nor hurry to make pesin leader and nor rush put hand for en head, so dat yu nor go karry anoda pesin sin for yor head. Make yu keep yorsef pure.


How pesin go prish God word wen God nor send am? As God word sey, “Pipol wey dey prish di Good News dey waka well, bikos na good tins dem dey bring!”


From der, dem enter ship go Antiok, where dem for first pray for dem, for di work wey dem just finish naw.


Wen dem don choose eldas wey go lead di bilivers for di difren-difren church, dem kon pray and fast sey, make God protet dem.


E put en hand for Joshua head kon sey na-im go take-ova from am. E do evritin, just as God kommand am.


Na dis make mi dey remind yu sey, make yu dey use God gift wey yu get well and yu receive dis gift afta I lay hand for yor head.


but Paul choose Silas and dem go meet di brodas and sistas kon pray make God bless dem.


Dem don even tok about yor love for inside di church where God pipol gada. E go good sey wen dem kom yor side, make yu help dem, so dat belle go sweet God as dem dey kontinue dia journey.


So Ananias go di house and wen e enter, e put en hand for Saul head kon sey, “Broda Saul, di Oga God wey show ensef to yu for road wen yu dey kom here, na en send mi kom meet yu, so dat yu go fit si again kon receive di Holy Spirit.”


E don rish eighty-four years since en husband die. E nor dey komot for di temple, e dey serve God and dey fast and pray day and nite.


Den dem kon pray, “Oga God Jesus Christ, na yu know wetin dey inside evribody mind. Make yu show us di pesin wey yu wont among dis two pipol,


So Banabas and Saul wey di Holy Spirit send kon go Seleucia and from der, dem enter ship go Cyprus.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka