Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Acts 12:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Wen e don katch Pita put for prison, e put four gangs, wey get four four soldiers each, make dem guide am. Herod plan na to bring Pita out make e judge am for di whole town front wen Passova don finish.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Acts 12:4
22 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Pita tell am, “Oga God, I dey ready to follow yu go prison and even die with yu.”


Pipol fit plan difren-difren tins, but na wetin God tok, go happen.


“But before dem go happen, dem go arrest and ponish una for wetin una nor do, den go karry una go judge for inside sinagog, den dem go trow una inside prison. Dem go karry una go meet kings and govnors, bikos of my name.


and dem dey do wetin yu don already plan sey go happen.


So dem arrest dem put for prison till di next day, bikos nite don rish.


I tell yu true word, wen yu dey small, yu dey do as yu like, dey dress as yu like and dey go anywhere wey yu wont, but wen yu go old, yu go spread yor hand and oda pipol go help yu tie yor klot and karry yu go where yu nor won go.”


But dem sey, “Make wi nor do am wen di Feast don start, so dat pipol nor go make trobol.”


“Dem go karry una wey bi my disciples give pipol wey go sofa and kill una. Bikos of mi, pipol for difren town wey nor know God, go hate una.


Make yu nor boast about tumoro, bikos yu nor know wetin go happen between naw and den.


Di messenjas take di kommand go all di aria for di kingdom. And di law wey dey inside sey for di thirtint day for Adar mont, dem must kill all Jew pipol; weda dem yong or old, both wimen and shidren kon take all dia propaty.


But Saul try to distroy di church; e dey go from house to house dey arrest men and wimen put for prison.


so dem kon arrest di apostles put for prison.


Wen di sojas don nail Jesus for cross, dem tear en klot and dem for kon divide am. But dem leave di fine koat (bikos e nor get where dem join am, since dem weave-am from top go rish bottom).


So, na who fit tok make sometin happen, if God nor allow am?


God tell Moses and Aaron for Egypt,


Two days before Passova and di Bread wey nor get yist Feast, di priest oga dem and di law tishas kon dey find as dem go take arrest Jesus, make dem for kill-am.


Wen e si sey di Jew pipol happy with wetin e do, e kon arrest Pita too. (Dis tin happen for di time wey dem dey do di bread wey nor get yist feast.)


So as Pita dey prison, di pipol wey dey di church dey pray to God for am, day and nite.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka