Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Acts 10:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 One man wey en name bi Kornelius dey stay for Caesaria and e bi offisa for Italy soja.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Acts 10:1
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen dem don gri sey wi go travel inside ship go Italy, dem kon karry Paul and some oda prisonas give Julius, one kommander wey dey Augustan group.


Di sojas take Jesus Christ enter di govnor house and all of dem kon gada am.


Filip si ensef for Azotus and as e dey waka pass for di aria, e kon dey prish di Good News for all di towns till e rish Caesaria.


But bikos di soja offisa one save Paul life, e nor kon let dem do wetin dem plan. E kommand di pipol wey fit swim, make dem first jump komot from di ship swim go land


Wen three days don pass, Festus komot from Caesaria go Jerusalem.


Wen di sojas oga and di pipol wey dey guide Jesus Christ si di eartkweke and wetin happen, dem fear well-well kon sey, “True-true dis man na God Pikin.”


but Paul tell di offisa and sojas, “Unless all dis men stay inside di ship, all of us go die.”


Afta some days, King Agrippa and Bernice go Caesaria, go salot Festus.


Wen di men wey dey ride horse rish Caesaria, dem kon take Paul and di leta give di govnor.


Den e koll two soja oga kon tell dem, “For nine oklok dis nite, make una ready two hundred sojas wey go-go Caesaria, plus seventy, wey go ride horse and two hundred, wey go karry spear.


Wen dem don put am for groun make dem start to flog am, Paul kon ask di soja wey stand near am, “E dey rite make una flog pesin wey bi Roman citizin, wen dem neva judge en kase?”


Di next day, wi leave der kon go Caesaria. For der, wi enter Filip house. Dis Filip na evangelist and e dey among di seven deakons wey dem choose for Jerusalem, den wi kon stay der with am.


Den di sojas with dia oga and di Jew oga dem take Jesus kon tie am with rope.


So Judas kon escort many soja, some Temple polise and Farisee pipol enter di farm. Dem whole lamp, tosh and some whole swod and stik for hand.


For der, one Roman soja get one savant wey e like well-well, but di savant nor well and e nearly die.


So di sojas push Jesus enter di varanda for di govnor palis kon koll evribody gada.


Afta dem don travel for one full day, dem kon rish Caesaria. Kornelius don gada all en family and friends dey wait for dem.


As dem dey try to kill-am, news kon rish di kommanding offisa for di Roman soja wey dey guide di town sey, di whole Jerusalem don skata.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka