Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




2 Samuel 8:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Den e build soja kamp for dia aria and dem kon dey pay dia tax to am. God make David win for evriwhere.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




2 Samuel 8:6
26 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

E build soja kamp for evriwhere for Edom and di pipol for der kon dey under en pawa. God make David win for evriwhere.


My God wey get pawa, di strong One wey save mi, na Yu protet mi wen my enemies dey fight mi.


E pak sojas full Judah towns kon send some go difren place for Judah land and for Efraim towns wey en papa seize.


I dey follow yu go anywhere wey yu dey go and I dey make yu win all yor enemies as yu dey fight. I go make evribody know yu for evriwhere, just as dem know all di big leaders for di world.


Pesin fit ready en horse sey e dey go fight war, but na only God go gi-am viktory.


E put guards for Edom. Na King David dey rule all di pipol for der and God make David win all en war.


Dat time, David dey for one hill wey dem guide, while some Filistia pipol don take-ova Betlehem.


E win Moab pipol too. E make dem liedan for groun kon divide dem group by group and for evry three group, e kill two. So Moab pipol kon dey work and pay dia tax give David.


Naw, una shance don kom. Make una remember sey God sey, ‘I go use David my savant take save Israel my pipol, from Filistia pipol and all dia oda enemies.’ ”


Den fear kon katch di remainin Filistia sojas wey dey di kamp, field and evriwhere. Dem fear and di eart kon dey shake. Na God kause dis fear.


Jonatan kon tell en savant, “Kom make wi go di oda side go meet all dis men wey dem nor sekonsaiz. May bi God fit fight for us. Nor-tin go fit stop God to save us, weda dem many or small.”


One day, Saul pikin, Jonatan kon tell en savant wey dey karry en tins, “Make wi go Filistia sojas kamp wey dey di oda side.” But e nor let en papa know.


Leta, Jonatan kill Filistia sojas for Gibeah and all Filistia pipol kon hear about am. Den Saul blow trumpet take koll all di Hibru pipol make dem kom fight.


Di gold shield wey Hadadeza take dey guide ensef, David karry am go Jerusalem.


Wen di kings wey dey follow Hadadeza si sey Israel sojas don win dem well-well, dem kon go make peace with David and dey obey am. So, Siria pipol nor gri help Ammon pipol again.


Na Solomon dey kontrol all di nashons from Eufrates River go rish Filistia and Egypt borda. Dem dey under am dey pay tax gi-am till e die.


David kon dey strong evriday, bikos Oga God wey dey mighty, dey with am.


Afta Ahab don die, Moab pipol kon go fight Israel pipol.


King Mesha for Moab dey barb sheep hair and e dey always give Israel king 100,000 lamb and 100,000 rams wool,


Di remainin tins wey Jeroboam do, plus all wetin e get and en viktory wey make Israel take-ova Damaskus and Hamat, dem rite all for Israel kings history book.


God dey with am, so evritin wey e dey do, dey prosper. E fight against Assyria pipol and e nor fear dem.


My God, Yu don rijet us? Yu nor go follow awa sojas go war again?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka