Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




2 Samuel 8:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 E win Moab pipol too. E make dem liedan for groun kon divide dem group by group and for evry three group, e kill two. So Moab pipol kon dey work and pay dia tax give David.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




2 Samuel 8:2
22 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

‘I don si am, but nor bi naw e go happen; Even doh I hold am, e nor dey near my hand. One star go kom out from Jakob pipol. E go kom out from Israel like septa. E go kill Moab pipol and Seth sons.


But Moab wey I dey use as my wosh-hand basin, go bi my savant and I go use Edom take klean my legs kon happy, bikos I don win Filistia pipol.”


Den e build soja kamp for dia aria and dem kon dey pay dia tax to am. God make David win for evriwhere.


But some wiked pipol sey, “How dis man go fit take save us?” Dem curse am and dem nor gri kom gi-am gift. But Saul nor tok anytin.


“Make una nor listin to Hezekaya! And naw, Assyria king dey kommand una sey, make una surenda. Dem go let all of una chop grapes from una own vine and figs from una own trees kon drink wota from una own well,


But Moab na my wosh-hand basin; dem bi my savant and I go use Edom take klean my legs kon happy, bikos I don win Filistia pipol.”


Ammon pipol dey respet Uzzaya well-well, so e kon get pawa and e rule go rish Egypt side.


E still win Moab pipol kon bigin rule and kollect tax from dem.


King Shalmanesa for Assyria treaten am; so Hoshea kon bi en savant and e dey pay tax to am.


Afta Ahab don die, Moab pipol kon go fight Israel pipol.


David use di town pipol take work well-well with saw, iron hoes and axe, den e force dem make bricks. Na so e do give di pipol wey dey di oda towns for Ammon. Den en and en men kon go back to Jerusalem.


Afta Saul don bikom Israel king, e fight all dia enemies wey dey round dem wey bi: Moab, Ammon and Edom pipol, Zobah king and Filistia pipol. Anywhere e for go fight, God dey make am win.


Dem wey gada so na: Edom and Ishmael pipol, Moab and Hagrit pipol;


Den, David from der go Mizpa for Moab, where e for tell Moab king sey, “I beg! Make yu allow my papa and mama stay with yu until I know wetin God won take mi do.”


So David papa and mama kon stay with Moab king; dem stay with di king thru-out di time wey David dey run waka.


Na Solomon dey kontrol all di nashons from Eufrates River go rish Filistia and Egypt borda. Dem dey under am dey pay tax gi-am till e die.


Dem nor get strent again and dem even dey fear for dia house.


My God, Yu don rijet us? Yu nor go follow awa sojas go war again?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka