Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




2 Samuel 8:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Afta sometaim, King David attack Filistia pipol again, e win dem kon take dia land wey bi Meteg Ammah from dia hand.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




2 Samuel 8:1
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I dey follow yu go anywhere wey yu dey go and I dey make yu win all yor enemies as yu dey fight. I go make evribody know yu for evriwhere, just as dem know all di big leaders for di world.


But Joab and Abishai bigin porshu Abner from evening till dem rish Ammah hill, near Giaya wey dey east for di side wey dey di road wey dem dey pass go Gibeon wildaness.


na faith dem take win kingdoms; do wetin good for God eye; kon get di tins wey God promise dem; klose lion mout;


kwensh fire wey dey burn well-well and eskape wen dem won kill dem with swod. God turn dia weakness to pawa. Dem strong well-well for war front and sojas from oda kountries, dey run from dem.


All di pipol for Israel kon dey kworel among demsef sey, “King David save us from awa enemies. E save us from Filistia pipol, but naw, e don run komot from di kountry bikos of Absalom.


Yu save mi from my own pipol wey fight mi kon make mi dey always rule di nashons and even pipol wey I nor know, dey under mi.


Yu make mi win doz wey dey akuiz mi. Yu make mi rule oda nashons and pipol wey I nor even know, dey serve mi.


But Moab wey I dey use as my wosh-hand basin, go bi my savant and I go use Edom take klean my legs kon happy, bikos I don win Filistia pipol.”


So Israel pipol win Filistia pipol and dem nor fight Israel pipol again. Thru-out Samuel time, God dey against Filistia pipol.


Dem tell Filistia pipol sey dem don make David king for Israel, so dia sojas kon ready to go fight am. Wen David hear am, e kon go di aria wey dey save.


David do wetin God kommand and e drive Filistia pipol from Gibeah go rish Geza.


Yu shake di eart kon tear am into two. So, make Yu join where divide, bikos di eart don dey fall.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka