Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




2 Samuel 7:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Wetin I go tell Yu again? Yu know mi well-well, but Yu still dey respet mi wey bi yor savant.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




2 Samuel 7:20
9 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Jesus ask am di third time, “Simon, John pikin, yu sure sey yu love mi so?” Pita kon dey vex, bikos e pain am well-well, as Jesus ask am di same kweshon three times, “Yu sure sey yu love mi so?” Den Pita sey, “Oga God, yu know evritin, yu know sey I really love yu.” So, Jesus tell am, “Make yu feed my sheep.


But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”


My God, Yu shek my heart well-well and Yu know evritin about mi.


I go kill all en shidren, den all di church pipol go know sey, I know wetin dey for pipol mind and heart. I go reward evribody akordin to wetin e do.


Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tell am how wi live awa life.


E nor nid anybody to tok about am, bikos e know wetin dey inside pipol belle, so e nor fit trust dem.


I don choose am, so dat e go kommand en son and shidren-shidren sey make dem obey mi kon do wetin dey good and korrect. If dem obey mi, I go do evritin wey I promise am.”


Di man ansa, “Na mi bi di oga among God sojas for heaven. Naw I don kom!” Joshua fall face groun kon sey, “Wetin my oga won tell en savant?”


Wetin I won tell Yu again? Even doh Yu know mi well-well, Yu still dey respet mi wey bi yor savant.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka