13 Wen David don komot from Hebron go Jerusalem, e kon get many wifes, girl-friends and shidren.
Na David sons bi dis, dem nor kount di sons wey en girl-friends born for am. Tamar na dia sista.
Make di king nor marry many wife for ensef, bikos dem go turn en heart from di Oga una God. Make e nor gada money, silva or gold for ensef.
Abijah get pawa well-well, e get fourteen wifes, twenty-two sons and sixteen dotas.
So, David kon know sey God don make am king for Israel and E dey make en kingdom prosper, bikos of en pipol.
Solomon marry 700 wife kon get 300 girl-friends and na dem make am turn en heart from God.
David don already marry Ahinoam from Jezrel and di two of dem kon bi en wife.
Di rish man get many melu and sheep
Dis na shidren wey dem born for David wen e dey Hebron: Di first pikin na Amnon, en mama na Ahinoam wey kom from Jezrel: di sekond one na Daniel, en mama name na Abigail, wey kom from Karmel.