So di king do big party for dem and dem chop and drink. Den e send dem go back go meet dia oga. Afta dat, no soja for Siria ever kom fight against Israel pipol again.
Naw Joab and David ofisas dey kom back from fight with many tins wey dem karry. Abner nor dey Hebron with David again, bikos David don tell am make e dey go, sey e dey save.