Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




2 Samuel 23:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 bi like sun wey shine for morning; di sun wey dey make grass shine afta rain don fall put.’

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




2 Samuel 23:4
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

My God, make all yor enemies die like Sisera! But make doz wey love Yu, shine like sun!” So peace kon dey for di land for forty years.


Wen di king dey rule, e go bi like wen rain fall on-top grass wey dem kut; e go bi like rain wey dey wota di groun.


Na dis make mi send my profet kom give una di judgement and distroshon message. Just as day dey break for morning, na so too, my judgement go kom meet una.


en shidren-shidren go bi king forever and en kingdom go dey forever like di sun.


E kom bear witness for di lite, make evribody for fit get di shance to bilive wetin God tok thru en word.


But for una wey dey fear my name, my sun wey dey give life go shine and heal una. Una go dey free kon dey happy like melu pikin wey dem open en kage make e for go play.


Den Israel pipol wey survive go bi like dew for morning wey God send kom di nashons; like rain wey go make plant grow and e nor dey wait for man before e fall.


So make wi serve God. As far day dey break and rain dey fall for di eart, E go kom save us.


Nashons go kom enter una lite and kings go enter una brite lite.


Jerusalem pipol, make una raiz and shine like sun, bikos God glory dey shine on-top una!


For dat time, God go make evry plant and tree grow big and fine well-well again. All di pipol wey go survive for Israel, go like di tins wey di land go produce.


Raitious pipol ways bi like sun for morning wey dey shine well-well go rish evening.


Wen yu go war, yor pipol go dey happy to follow yu go fight. Na holy garment dem wear for yor body and yor pawa go dey fresh evriday like morning dew.


Make wetin I dey tish una, fall on-top una like rain; make wetin I dey tok bi like dew for morning. Make my words fall like rain on-top grass and make e bi like shawa on-top plant wey just dey grow.


bikos dis na wetin God tell mi, “Just as dew dey form for nite wen harvest time rish and as sun dey shine for day time kon make evriwhere hot, na so too I go kwayet dey look una from heaven where I dey stay.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka