Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




2 Samuel 2:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 Abner koll Joab kon sey, “Na so wi go dey fight forever? Yu nor dey si sey wi nor go gain anytin, apart from wahala? Wi bi yor kountry pipol. Wen yu go tell yor men make dem stop to porshu us?”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




2 Samuel 2:26
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

“Make yu shaut am for Egypt, Migdol, Memfis and Tahpanhes sey, ‘Make una ready to defend unasef, bikos dem go kom fight and distroy evritin where una get!’


Di next day, Moses si two Israel men dey fight and e won try setol dem. So e tell dem, ‘My pipol, una bi brodas, why una kon dey fight unasef like dis?’


Na God wey dey mighty get today. Today, E go take revensh kon ponish all en enemies. En swod go kill all of dem. God wey dey mighty don sakrifice doz wey fall for en trap for di nort side for Eufrates River.


War go kom dia towns kon break and skata dia gates. Enemies go distroy my pipol for where dem tink sey nor-tin go fit happen to dem.


Pipol don tif all di tins wey dey di land. I send sojas go distroy di land and nobody for der go get peace.


Na how long I go dey si awa enemies war flag and hear dia trumpet sound?”


“Even as I ponish una shidren rish, dem nor gri shange or listin as I dey korrect dem. Just as lion dey kill en enemy, na so too una don kill una profets finish.”


But if una sin against mi, una go die. Mi, wey bi God, don tok.”


To start kworel bi like wen yu leave wota make e dey rush; so e go good make yu stop am, before e go kause big wahala.


Na how long pipol go take dey tok bad about mi? How long una go dey tok wetin I nor do? How long una go kontinue to dey lie for my head?


“Bildad, na wen yu go stop to ponish and worry mi with yor words?


“Job, wen yu go stop to dey tok? If yu stop, wi go tok to yu.


David tell di messenja, “Tell Joab make e nor fear or vex, bikos dem nor dey know who go die for war. Tell am make e attack di town well-well kon win am.”


All of dem kut demsef for head, use swod shuk each oda for belle and di twenty-four men fall for groun die togeda. So dem koll dat place for Gibeon, “Swod Field.”


Abner kon tell Joab, “Make wi let some boys from di two side fight face-to-face.” Joab kon ansa, “Okay.”


Di men wey kom from Benjamin tribe kon gada round Abner on-top di hill.


Joab ansa, “I use Oga God name take swear sey, if to sey yu nor tok, my men for porshu yu rish tumoro morning.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka