Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




2 Samuel 17:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Yu know sey, David yor papa and en men strong well-well for fight, like bear for bush wey dey find en pikin. Yor papa na soja wey get sense and e nor dey stay with en men for nite.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




2 Samuel 17:8
20 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I go attack una like bear wey en pikin lost kon tear una to pieces. As lion and wiked animals dey distroy tins, na so too I go distroy una.


One of en savant kon sey, “I don si one of Jesse pikin wey dey Betlehem wey know how to play di jita. E dey strong and e get mind; e know book and e fine well-well, bikos God dey with am.”


“Di sekond beast bi like bear. Dem karry am for one side. E get three rib for en mout and dem dey en tit centre. So I hear wen one vois tell am, ‘Get up make yu go chop pipol until yu beleful.’


E betta make wiked animal attack pesin, dan to listin to wetin foolish pesin dey tok.


Just as pipol dey fear hongry lion and wiked bear, na so too poor pipol nor fit fight wiked ruler.


So Elisha turn look dem kon curse dem with God name. Den two woman bear kom outside from di wood kon kill forty-two of di boys.


Joab broda, Abishai wey dia mama na Zeruaya, na leader for di three. E use en spear take fight against three hundred men kon kill dem and en name dey famous among di three.


Di three sojas wey get pawa well-well kon force demsef pass Filistia pipol kamp and dem draw wota from di well kon go give David. But e nor gri drink am; instead, e pour am as ofrin for God


All di ofisas stand near am as di royal bodyguard pass go en front. Di six hundred sojas wey follow am from Gat still pass go en front,


Make una take time find di real place wey e dey, den kon tell mi. Den I go follow una go. If e dey di land, I go find am among doz wey dey Judah.”


David win di Filistia man with di katapault and stone. E shot di Filistia man fall kon kill-am. David nor even get swod for en hand.


So Dan men tell am, “Mind wetin yu dey tok! Unless yu wont make all dis men attack kon kill yu and yor family.”


E fit hide for kage and oda place dis time. If David attack and win yor men, anybody wey go hear am go sey, dem don win una.


“Una mama na really strong lion wey train en shidren for where oda wiked lions dey.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka