2 Samuel 16:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
4 Di king tell Ziba, “Evritin wey Mefiboshet get, don turn yor own.” Ziba ansa, “I go always bi yor savant! Make I always dey do wetin dey good for my king eyes!”
Make una nor hold anybody sey e do bad, if na only one pesin bi witness. Di trut for di matter bi sey, two or three pesin must sey dem si wetin happen.
Wen Mefiboshet wey bi Jonatan pikin and Saul grand-pikin rish der, e show respet to David kon bow for en front. David koll am, “Mefiboshet!” E ansa, “My oga, I bi yor savant.”
Di king ask am, “Where Mefiboshet, yor masta, Saul grand-pikin?” Ziba ansa, “E dey for Jerusalem, bikos dem tell am sey Israel pipol go gi-am en grand-papa Saul, kingdom back.”