Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




2 Samuel 1:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 I love Saul and Jonatan well-well. Deat nor go fit separate dem. Dem fast pass eagle and strong pass lion.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




2 Samuel 1:23
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Yes, di enemies go kom like kloud. Dia shariot bi like strong breeze and dia horse fast pass eagle.” Den I kon kry, “Wi don die finish o-o, bikos dem go distroy us!”


So for di sevent day, as evening dey rish, di men kon tell Samson di ansa sey, “Na wetin go fit dey sweet pass honey or wish tin or animal strong pass lion?” But Samson ansa dem, “If to sey, una nor work with my melu, una nor for know di ansa.”


Doz wey dey porshu us, fast pass eagle wey dey fly for sky. Dem porshu us pass di mountin kon set trap for us for wildaness.


“ ‘Lion wey bi animals king wey nor dey run for anytin.


My life just dey rush pass like speed boat; like eagle wey won katch rabbit.


Wen David don tok to Saul finish, en and Jonatan kon turn tait friend. Jonatan like David as e like ensef.


God go bring some pipol from far against una and dem go kill una like vulture. And dem bi pipol wey una nor go undastand wetin dem dey tok;


Some strong sojas for Gad wey dem don train for war kon go join David too. Dem dey karry shield and spear. Dem bi like wiked lion and dem dey run fast like deer wey dey di hill.


Benaya, wey bi Jehoiada pikin, wey kom from Kabzeel, na anoda popula soja. E do many strong tins kon kill two men among Moab strong sojas. One day, e still waka enter one pit go kill lion.


Jonatan ansa am, “Nor-tin go fit kill yu! My papa nor go fit do anytin escept e tell mi first. Wetin make my papa nor gri tell mi about dis matter? E nor go fit happen!”


Zeruaya three sons dey der wey bi, Joab, Abishai and Asahel. Asahel dey run fast-fast like deer for bush, so


Israel wimen, make una mourn for Saul! E dey give una fine klot, jewel and gold.


En mout sweet well-well to kiss and evritin about am, dey sweet mi for body. So, Jerusalem wimen! Dis na wetin my love bi like.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka