2 Samuel 1:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
10 “So I kon go kill-am, bikos I know sey e go die. Den I komot di crown from en head and di shain from en hand. So my oga, I don bring dem kom give yu.”
E kwik-kwik koll di pesin wey karry en weapon kon tell am, “Make yu kill mi with yor swod, so dat dem nor go sey, ‘Na woman kill mi.’ ” So di pesin use en swod take shuk am and e kon die.
David take gold crown from Ammon pipol juju wey bi “God Milkom” and di gold heavy rish seventy-five pound and jewel dey inside am too. David take am kon wear am for en own head. E still karry many tins from di town.
Den di king kon tell Doeg, “Make yu kill di priests.” So Doeg wey kom from Edom kon turn kill di priests. For dat day, e kill eight five men wey wear linen priest garment.
So Adoni-Bezek sey, “I don kut seventy kings hand and leg komot wons and I make dem chop food from under my tabol. But naw, God don pay mi back for wetin I do to dem.” So, dem karry am go Jerusalem and e die for der.