Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 9:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 (For dat time for Israel, if anybody won go hear from God, e go sey, “Kom make wi go si di pesin wey dey si vishon.” Bikos dat time, dem dey koll profet, “Pesin wey dey si vishon.”)

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 9:9
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Dem tell di pesin wey dey si vishon sey, “Make yu nor si any vishon for us” and dem tell di profet sey, “Make yu nor tell us di rite tin again!” Dey tell us betta and sweet tins. Make yu just dey lie give us.


So Amazaya sey make dem tell Amos, “Komot for here, yu wey dey profesai! Yor tok don too mush! Make yu go Judah town and kontinue to prish for der, so dat dem go pay yu.


Evritin wey David do from biginnin go rish end, dem rite am both for Profet Samuel, Profet Natan and Profet Gad book.


Evritin wey Profet Samuel, Kish pikin Saul, Ner pikin Abner and Joab pikin Zeruaya dedikate give God for di temple, na Shelomit and en rilashons dey guide dem.


God really warn Israel and Judah pipol thru all en profets and doz wey dey si wetin go happen sey, “Make una turn from sin kon obey my kommand and laws wey dem rite for una. Na mi sey make una grand-grand papa dem keep dis law and I dey send my savants kon remind una about am.”


Den God tell Gad wey bi David profet, “Go tell David sey I dey gi-am three tins and make e choose one of dem


God don make una dey do like sey una don drink, so una go sleep go. God don blind di profets eyes and doz wey dey sey future nor go fit si anytin again.


But di shidren kon dey struggol inside am, so di woman kon sey, “If na so e go bi, I nor sure sey I like get belle!” So di woman ask God


Asa vex well-well for di profet, so e kon put am for prison. Dat time, King Asa still vex opress some pipol.


For dat time, Profet Hanani visit King Asa for Judah kon tell am: “Bikos yu bilive Siria king pass God, yu nor go fit win Siria sojas again.


All di men wey guide di gates na 212. Dem register dem akordin to where dem stay. Na King David and Samuel wey bi profet, put dem for dis pozishon.


Afta Joshua die, Israel pipol kon ask God, “Na wish tribe go first go attack Kanaan pipol?”


Saul tell en savant, “Yu wise well-well! Kom make wi dey go.” So dem kon go di town where God savant dey.


Den dem tell am, “Ask God for us weda awa journey go get head.”


If to sey di whole body na eye, wi nor for fit hear anytin and if to sey all di body na ear, wi nor for fit smell anytin.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka