Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 9:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 But di savant ansa, “Si, one God savant dey dis town wey evribody dey respet. Evritin wey e tok really dey happen. So make wi go der, may bi e fit tell us wetin wi go do.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 9:6
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Dis na di blessing wey Moses, God savant bless Israel pipol before e die:


God tell one profet from Judah make e go Bethel and e rish der wen King Jeroboam stand for di altar dey do sakrifice.


But yu wey dey serve God, make yu nor put hand for all dat kind tin. Instead, make yu dey struggol to do wetin dey rite and good; dey keep yor promise; dey love; get patient and dey gentol.


Bikos of di work wey dem dey do, make una love and respet dem well-well.


As wi dey live with una wey bilive Christ, una and God na awa witness sey, wi dey holy and dey do good tins for God eye without fault.


Heaven and eart go vanish, but my word go still dey.


But wen my savant tok wetin go happen; wen I send my messenjas go tell una wetin I plan, I dey make doz plans, happen. I tell Jerusalem sey pipol go stay for der again and dem go ribuild Judah town. Even doh dem skata am before, I go raiz am up again.


So Elisha ask, “Na wish side e fall put?” So di man show am where e fall put, den Elisha kut small branches for di tree kon drop am put for der, den di axe head kon float kom up.


One man of God kom Eli house kon sey, “Dis na wetin God tok: ‘Wen Aaron and en family bi slave for Egypt, I show mysef to Aaron.


“Wen I rish di well today, I kon pray sey, ‘My Oga wey bi my oga Abraham God, if Yu know sey Yu go make my journey well, make evritin happen as dem suppose bi.’


Di savant ansa, “Si, I still get small money for my hand. Wi go gi-am to God savant and e go tell us wetin wi go do.”


Di king tell Zadok, “Look! Make yu take Ahimaaz yor pikin and Jonatan wey bi Priest Abiatar pikin kon go di town back with peace.


Wen Elisha, God profet hear sey di king tear en klot, e kon send pipol go meet and tell di king, “Wetin make yu tear yor klot? Send am kom meet mi and e go know sey Israel really get betta profet wey God send kom.”


How wi go take know doz wey dey fear God? Na doz wey God go show di rite road wey dem go follow.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka