Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 9:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 And wen una enter di town, una fit si am, before e go-go chop for di altar for di hill. Di pipol nor go chop until e kom, bikos e must bless di sakrifice. Wons e don bless am, doz wey dem invite go bigin chop. Naw make una dey go, bikos na naw una go fit si am.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 9:13
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Jesus take di bread kon tank God. Den e divide am give di pipol wey sidan. E do di same tin with di fish. All of dem chop as dem wont kon beleful well-well.


Bikos evritin wey God kreate, dey good and wi nor suppose rijet any food, so-far wi don tank God for am,


If I tank God for my food, wetin go make anybody fight mi bikos of di food wey I tank God for?


So some kenu wey kom from Tiberias kon rish di wotaside near di place wey dem for chop bread, afta Jesus don pray.


E sidan for where dem dey chop; e take bread, bless am kon divide am give dem.


Jesus take di five bread and two fish, e look heaven kon tank God, den e divide di bread. E give en disciples make dem share am for di pipol and e kon divide di two fish among dem too.


As dem dey chop, Jesus take bread kon tank God, afta e divide am, e give en disciples, kon sey, “Make una chop, dis na my body.”


Den e tell di pipol make dem sidan for di grass. E take di five bread and two fish face heaven kon tank God. Afta e don tank God, e share di bread give en disciples make dem give di pipol.


Den Jesus take di five bread and two fish, e look heaven, tank God, den e kon divide dem. E give di bread and fish to en disciples, make dem share am for di pipol.


Den I go choose one priest wey dey loyal. E go do wetin dey inside my heart and soul. I go gi-am shidren wey go always dey serve for front of di one wey I choose.


So dem kon waka enter di town. As dem dey waka go di town centre, Samuel dey waka kom dia way and e dey go di altar for di hill.


Na two hundred men from Jerusalem, Absalom karry follow body. Bikos dem nor know wetin Absalom won do, dem kon follow am with klean mind.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka