12 Samuel put one stone between Mizpa and Shen. E koll di place Ebeneza, bikos e sey, “Na God help us rish here.”
E save us from deat and E go diliver us. Wi don put awa hope for en hand sey E go diliver us again.
For di river centre where di priests wey karry di Kovenant Box stand put, Joshua kon put twelf stones for der. Di stones still dey der still today.
But God don dey help mi till today, so I stand dey tell evribody, weda dem bi small pikin or big pesin. So, wetin di profets and Moses tok sey go happen, naim I dey tell una so,
So Abraham koll di place, “Jehovah-Jireh, wey mean (God dey provide).” And till today dem dey sey, “For God mountin, E go provide evritin.”
So Jakob arrange some stone for di place where God for tok to am. E kon use drink take do ofrin for God, den e pour oil put.
Naw, Filistia pipol don karry God Kovenant Box from Ebeneza go Ashdod.
For dat time, dem go build one altar for God for di middle for Egypt, with one holy pila wey dem go dedikate give God for Egypt boundary.
My God, na from wen I bi small pikin, Yu dey tish mi yor ways and I always dey tell pipol about di wonderful tins wey Yu don do.
Yes! Yu don dey with mi since wen dem born mi and Yu dey kare for mi from my mama belle. No wonder I dey always praiz Yu!
Den Samuel tell Israel pipol wetin God tok. Israel pipol kon go fight Filistia pipol. Dem kamp for Ebeneza and Filistia pipol kamp for Afek.
So Moses build one altar kon koll am, “Na di Oga God bi my banner,”
Den, Israel men kon from Mizpa porshu Filistia pipol kon kill dem rish one aria for Bet-Car.
Den Saul build one altar for God and dis na di first time wen e dey build altar for God.