Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 7:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 As Samuel dey burn di ofrin, Filistia pipol dey kom fight Israel pipol. But for dat day, God kon send tonda from heaven go meet Filistia pipol. E make dem fear well-well and Israel pipol kon kill dem well-well.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 7:10
21 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God go skata en enemies; E go skata dem with tonda from heaven. God dey judge di world from biginnin go rish di end. E go give en king pawa kon honor di one wey E anoint.”


Abi nor bi di time to harvest grain bi dis? I go koll God, so dat E go send betta tonda and rain kom. Make una open una eye kon si how una don sin rish, wen una ask God for king wey go lead una.”


From di sky, di stars dey move and fight against Sisera.


God make dem fear as dem si Israel pipol. Israel pipol really kill dem for Gibeon der. Israel pipol porshu dem pass Bet-Horon kon dey kill dem until dem rish Azeka and Makkedah.


Den e tell mi, “Dis na wetin Oga God dey tell Zerubabel: ‘Nor bi with force or human being bin pawa, but na with my Spirit.’


Den war start for di town bikos Israel pipol bigin serve oda gods. But e get any man for Israel among di 40,000 men wey karry shield or spear go fight?


Wen Barak attack, God kon konfuse Sisera and en men. Sisera kom down from en war horse kon take leg dey run.


Den, Israel men kon from Mizpa porshu Filistia pipol kon kill dem rish one aria for Bet-Car.


Den fear kon katch di remainin Filistia sojas wey dey di kamp, field and evriwhere. Dem fear and di eart kon dey shake. Na God kause dis fear.


God vois dey sound on-top di sea and en vois bi like tonda, bikos na en bi di God wey dey kause tonda on-top strong sea.


God vois get pawa well-well; en vois get glory.


God go make una win una enemies wen dem attack una. Dem go from one side attack una, but dem go skata and run from una for seven side!


Den as God kommand and as E just breath, di sea bottom open and di eart foundashon kon dey show.


E skata en enemies kon disgrace dem forever.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka