Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 6:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Dem kon ask, “Na wetin bi di ofrin wey wi go karry follow am?” Di priest and doz wey dey si vishon kon ansa, “Una leaders na five. So make una karry five gold sore and five gold rat, bikos na di same sickness do una with una leaders.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 6:4
10 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na di nashon dem bi dis: Filistia pipol (doz wey dey under di five Filistia rulers), all Kanaan, Sidon and Hiv pipol wey dey stay for Mount Lebanon; from Baal-Hermon mountin go rish Lebo-Hamat.


from Shihor River for Egypt east go rish di nort side wey face Ekron (dem dey koll am Kanaan aria), plus di aria wey bi di five Filistia pipol oga own for Gaza, Ashdod, Ashkelon, Gat and Ekron; plus Avvim pipol land


But afta dem don komot am, God attack di town again kon make all of dem dey fear. E make sore full di pipol body.


God really attack di pipol wey dey stay Ashdod and E kause betta wahala for dem. God put sore for all di pipol body, both doz wey dey Ashdod and doz wey dey stay near der.


Una go make image wey bi like di sore and rat wey dey distroy di whole land, den kon honor Israel God. May bi E go sorry for una, una gods and una land.


Doz wey nor die, get sore full body and di kry wey di town pipol dey kry, dey even rish heaven.


Israel pipol kon do as Moses tell dem. Dem ask Egypt pipol for silva, gold and klot.


Den make una take di Kovenant Box put for di truck kon add di gold tins wey una won give God join am, as ofrin for wetin una don do so. Den una go send am go.


At wons God Spirit enter Samson kon make am strong, so e go Ashkelon kon kill thirty men, den e take dia klot, kon give dem to di men wey solve di problem. Leta, e go back to en papa and mama house kon dey vex bikos of wetin happen.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka