Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 5:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 But wen dem wake-up di next day again, Dagon dey groun for di Kovenant Box front. Dis time, en head and hand don break komot and e liedan face di door. Na only di body remain.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 5:4
11 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I go skata all di image kon burn all dia juju propaty, bikos dem buy dem with ashawo money kon use dem pay ashawo for anoda place.”


“Make yu go tell di nashons di good news! Tell di pipol make dem listin well-well! Nor keep di news as sekret! Tell dem sey, ‘Dem go seize Babilon kon disgrace Bel and skata Marduk wey bi dia gods, den distroy all dia juju.


So Israel pipol make una tell di oda nashons sey: ‘Nor bi doz gods make di heavens and di eart. So dem go disappear komot from di eart and heavens.’


E go karry dia juju and all dia betta tins with silva and gold go back to Egypt. Afta many years wey peace don dey,


So like dis, God go forgive Jakob shidren and na like dat dem go take show sey dem nor go sin again. Dem go skata all di stone for dia juju altars kon distroy Asherah juju and all di incense altars.


Una go make image wey bi like di sore and rat wey dey distroy di whole land, den kon honor Israel God. May bi E go sorry for una, una gods and una land.


Pesin wey nor fit buy silva or gold go use wood wey nor go rust and e go find who sabi di work make e help am make image wey nor go skata.


All dis bad tins kon turn di pipol to fool and dem nor get sense again. So, disgrace go follow doz wey dey make juju, bikos di juju na lie-lie and dem nor get life at-all.


Di juju dey yuzles, so make dem distroy dem trowey and time dey kom wen God go ponish and distroy all of dem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka