Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 5:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Dem take di Kovenant Box go Dagon temple kon put am near Dagon.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 5:2
7 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Filistia rulers dey do party, offa sakrifice and dey praiz dia god wey bi Dagon kon dey sey, “Awa god don give us viktory ova Samson wey bi awa enemy!”


Instead, yu dey against God wey get heaven and eart. Yu bring all di tins from di temple, den yu and yor men, plus yor wife and yor girl-friends kon use dem dey drink wine. Yu dey praiz di gods wey dem make with gold, silva, bronze, iron, wood and stone; gods wey nor even fit si, hear or undastand! But yu neva ever praiz God wey dey kontrol yor life and ways!


As dem dey drink, King Belshazzar orda sey make dem bring all di gold, silva and bowl wey en papa Nebukadnezzar karry kom from God temple for Jerusalem. Di king sey make dem bring dem kom, so dat en, en ofisas, en wife and girl-friends go use dem drink wine.


Dem put en weapon for one of dia temple kon hang en head for dia juju wey dem dey koll Dagon, temple.


Dem even dey woship and offa sakrifice give dia net kon dey sey, “Na dis net bi di god wey make us get money well-well!”


Dem dey pass like breeze wey dey blow. But dem really dey guilty, bikos dem bilive sey, na dia pawa as dia god.”


Di next day wen Filistia pipol kom gada tins from di pipol wey dem kill, dem kon si sey Saul with en three shidren don die for Gilboa mountin.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka