Fear katch Filistia pipol, bikos dem fill sey difren gods don enter Israel kamp. Dem kon sey, “Dis one bad for us! Wi neva si anytin like dis before o-o!
Filistia pipol kommander si dem kon ask, “Wetin dis Hibru dey do for here?” Akish kon ansa, “Dis na David, King Saul savant and e don dey with mi for sometaim naw. E neva do anytin wey go make mi blame am since e don dey with mi.”