Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 3:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 One nite, Eli wey nor dey si well-well again dey sleep for en room

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 3:2
8 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Dis time, Eli na ninty-eight years. En eyes open, but e nor dey fit si well.


Na seventy years Yu give us! Some pipol even dey rish eight years. Even di estra years wey human being dey live, na pain and trobol full am; but di years go soon disappear and wi go fly go.


For dis time, Jakob nor dey si well again, bikos e don old well-well. So Josef take en sons near am well-well and en papa hold dem near en body kon kiss dem.


Wen Isaak don old well-well and e nor dey si well again, e koll en senior pikin Esau kon tell am, “My pikin!” Esau ansa, “Papa, na mi bi dis!”


But en papa sey, “My pikin, I know; I know wetin I dey do. Manasseh too go bi strong nashon and e go dey great. But even with all dis, en yonga broda go strong pass am and en shidren-shidren go many like san-san.”


Remember am before doz wey dey guide yor house bigin shake with fear. Dat time, yor strong men go don dey weak. Make yu remember am naw, before yor tit go pul finish and yor eyes nor go fit si well again.


Naw, wen Eli don old well-well, e kon dey hear evritin wey en boys dey do to evribody for Israel and how dem dey sleep with wimen for di temple door-mot.


So di woman go Profet Ahijah house for Shiloh. Profet Ahijah nor dey si again, bikos e don old well-well.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka