For morning go rish evening for dat day, di pipol try taya make David for chop sometin, but David don promise sey, “Make God ponish mi, if I chop anytin today!”
Where yu for die, I go die for der too and na der dem go beri mi put. Make God ponish mi well-well if I nor do wetin I promise! Na only deat go fit separate mi from yu!”
Den Daniel (wey en name na Belteshazzar) kon dey worry sotey e nor fit tok anytin. Di king kon tell am, “Belteshazzar, make yu nor let dis dream and en meaning worry yor mind.” Daniel ansa, “My king, e for betta sey dis dream na for yor enemy and wetin e mean, na for di pipol wey dey trobol yu!
Make pipol wey dey fear God beat and korrect mi with love! Make my head nor rijet good oil! True-true, even with all dia wiked plans, my prayers dey make dem fear.
David still tell dem make dem tell Amasa, “Una bi my own relashon, from today go, I dey put yu for Joab place make yu rule my sojas. Make God ponish mi if I nor do wetin I tok!”
But if really sey my papa get mind to kill yu, make God do all dis tin and many more to Jonatan if I nor kon tell yu, so dat yu go run go hide. Make God dey with yu, as E bin dey with my papa.
One day, King Zedekaya sey make dem bring mi kom meet am for di third gate wey dem dey pass enter di temple, den e sey, “I won ask yu kweshon and I wont make yu tell mi di whole trut.”