Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 24:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 David tell Saul, “Wetin make yu dey listin to pipol wey sey, ‘David won kill yu?’

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 24:9
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

If ruler dey listin to lie-lie word, den all en ofisas go dey plan wiked tins.


Di tongue na fire! Na der bad tins full pass for pesin body. E dey spoil di whole body and kause fire for pesin life and dis kind fire dey kom from hell.


Na only pesin wey yu hate, yu go like lie against and yeye words dey distroy pipol.


Just as heavy breeze from nort dey bring rain, na so too aproko dey make pesin vex well-well.


To do aproko, dey good well-well for mout wen yu dey tok am, bikos e dey sweet for body.


Wiked pipol dey listin to bad advise and doz wey dey lie, dey listin to lie-lie.


Wiked pipol dey do aproko waka; dem dey kause trobol and break friendship.


Wen dem trow dia leaders down from rock, di pipol go kom listin to my word wey go diliver dem.


I go distroy anybody wey dey plan bad for en neighbour and I nor go sorry for who dey deceive pipol or doz wey get pride.


So naw, make my oga di king listin to wetin en savant won tok. If na God make yu hate mi; if I offa ofrin to am, E go shange en mind, but if na human being make yu hate mi like dis, God curse go fall for dia head! Bikos dem don porshu mi komot from God land wen dem sey, ‘Make yu go. Go serve anoda god!’


Make una nor lie about anybody and if anybody dey pass thru problem for life; make una help am. Na mi bi God.


David run go Naiot for Rama. E go meet Jonatan kon ask am, “Na wetin I do? Na wish bad tin I do? Na how I take sin against yor papa? Bikos e won kill mi!”


David kom out from di rock kon shaut make Saul for hear, “My oga, di king!” Wen Saul look en back, David bow face groun for am.


Yu yorsef go know sey today God don put yu for my hand for inside di rock. Some of my men sey make I kill yu, but I sorry for yu kon sey, ‘I nor go do bad tin to my oga, bikos na God choose am.’


David still sey, “Wetin make my oga di king dey porshu en savant? Wetin I do? Wish bad tin I do?


Den I ask am, “Wish crime I kommit against yu, yor ofisas and di pipol, wey make una put mi for prison?


Wen di savant don go, David stand kom out from where e hide put near di stone, e knee down kon bow three times. Den dem kiss each oda kon bigin kry, but na David kry pass.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka