2 So Saul take 3,000 men wey e selet from Israel kon go find David and en men for di aria wey rock dey for where goats for mountin dey stay.
So Saul take 3,000 strong sojas wey e selet from Israel kon go find David for Zif desert.
Wen dem trow dia leaders down from rock, di pipol go kom listin to my word wey go diliver dem.
Wiked goat dey stay di high mountin; animals for rock dey-dey save inside dia whole.
Yet, my enemies still dey set trap to kill mi. Pipol wey hate mi dey plan to skata my life and na evriday dem dey plan against mi.
Wiked pipol dey set trap for God pipol, dem dey find ways to take kill dem.
Saul selet 3,000 men from Israel for ensef. 2,000 from di men, dey with Saul for Mikmash and for Bethel kountry for di hill; while di remainin 1,000 dey with Jonatan for Gibeah for Benjamin. E kon send di rest pipol go house.
“Na di Oga awa God dey protet mi; Na-im dey diliver mi.
Yu know how dem take born di goats wey dey stay mountin? Yu don si wen bush animals dey born before?
So Saul stop to porshu David and e kon go fight Filistia pipol. So dem kon dey koll dat place Sela Hammahlekot.