1 Wen Saul don porshu Filistia pipol kom back, dem kon tell am, “Si, David dey for En-Gedi desert.”
Di pipol dey deceive di king and en ofisas with all dia evil plans and di prince dem dey make di king happy with dia lie-lie words.
Some of una dey lie for pipol head, so dat dem go kill dem. Some dey chop food wey dem don sakrifice give juju and some like ashawo life.
If ruler dey listin to lie-lie word, den all en ofisas go dey plan wiked tins.
Nor let bad advisers near di king, so dat pipol go know am bikos e dey judge well.
Den Zif pipol go tell Saul for Gibeah sey, “David dey hide for Horesh near Hakilah Hill wey dey Jeshimon sout.”
Nibshan, di Salt towns and En-Gedi and dem bi six towns.
For En-Gedi go rish En-Eglaim wota, pipol dey go der go katch fish. Dem dey katch difren fish for der just as dem dey katch for Mediterranean Sea.