Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 23:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 So David ask God again. But God tell am again sey, “Make yu go save Keilah pipol. Bikos I don put Filistia pipol for yor hand.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 23:4
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God tell Gideon, “I go use dis three hundred men wey drink di wota like dog, take save and give yu viktory ova Midian pipol. So, make yu tell di remainin pipol make dem dey go dia house back.”


Den una go kom out from where una hide put kon distroy di town. Di Oga una God go give di town to una.


Elisha still sey, “Dis tin dey eazy for God eye. E go give Moab and en pipol to una.


David kon ask God, “Make I attack Filistia pipol? Yu go help mi win dem?” God ansa, “Yes! Make yu attack dem! I go give yu viktory!”


So Saul pray to God, but God nor gri listin to am. God nor even ansa am for dream or thru profet or Urim.


Den Gideon tell God, “Abeg! Make Yu nor vex for mi sey I still won tok, bikos I still like do one test with di wool and dis time, I like make di wool dey dry, while di groun go soak with wota.”


So dem kon ask God again sey, “Di man don rish here?” God ansa, “E hide ensef for back of di tins wey dem dey supply.”


So David ask God, “Make I go kill all dis Filistia pipol?” God ansa David, “Make yu go kill Filistia pipol kon diliver Keilah pipol.”


But David men kon tell am, “Wi still dey fear as wi dey here for Judah! How e go kom bi if wi go fight Filistia sojas for Keilah?”


So David and en men kon go Keilah go fight Filistia pipol. E karry dia animals kon kill dem well-well. Na so David take save Keilah pipol.


So David ask God, “Make wi porshu dem? Wi go katch dem?” God ansa, “Make una porshu dem, una go true-true katch dem kon diliver una wifes and shidren.”


Afta dis, David ask God, “Make I go stay one town for Judah?” God ansa am, “Yes! Yu fit go.” David ask again, “Na wish one?” God ansa, “Na Hebron.”


Dat nite, God tell Gideon, “Get up make yu go attack Midian pipol, bikos I don give yu viktory.


So David ask God, “Make I go attack Filistia pipol? Yu go dey with mi?” God ansa, “Yes! Go attack dem, bikos I go dey with yu!”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka