Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 22:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Den, David from der go Mizpa for Moab, where e for tell Moab king sey, “I beg! Make yu allow my papa and mama stay with yu until I know wetin God won take mi do.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 22:3
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But if di woman get shidren or grand-shidren, di first tin wey dem go do for dia family, na to show sey dem dey fear God, as dem dey kare for dia papa and mama. Dis na wetin dey make belle sweet God.


Afta Saul don bikom Israel king, e fight all dia enemies wey dey round dem wey bi: Moab, Ammon and Edom pipol, Zobah king and Filistia pipol. Anywhere e for go fight, God dey make am win.


So Samuel tell Eli evritin. E nor hide anytin from am. Eli kon sey, “Make God do wetin E like.”


Di wimen for di village kon sey, “Naomi don get boy pikin.” So dem koll am Obed. Na Obed bi Jesse papa and na dis Jesse born David!


I don buy Rut, wey kom from Moab, Mahlon wife, as my wife, so dat di propaty go still dey Elimelek family and en name go still dey among en pipol and en house. All of una na witness today.”


Dat time, God Spirit dey with Jeftah and e kon go Gilead and Manasseh town. E lead en sojas from Mizpa wey dey Jabesh-Gilead, go fight Ammon pipol.


Shidren! Make una respet una papa and mama, so dat una days for di land wey di Oga una God dey give una, go long well-well.


So Josef make en papa and brodas setol down. E give dem one aria for Egypt, di best aria for di land; wey bi Rameses land, just as Fero tok.


Doz wey dey face trobol or owe pesin or wey nor get wetin to do kon gada follow David and e kon dey lead dem.


So David papa and mama kon stay with Moab king; dem stay with di king thru-out di time wey David dey run waka.


E win Moab pipol too. E make dem liedan for groun kon divide dem group by group and for evry three group, e kill two. So Moab pipol kon dey work and pay dia tax give David.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka