Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 20:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 David ansa, “Tumoro na new moon and I suppose dey with di king for evening food. I go-go hide for di field for like three evening.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 20:5
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

And for di time wen una dey happy like di time for una festival or as di mont just dey start; una go blow di trumpet for una burnt ofrin and di sakrifice wey una dey do for peace ofrin, so dat God go dey remember una: Na mi bi di Oga una God.”


So e kon tell David, “My papa dey try to kill yu. So make yu take kare as yu dey waka for morning and find somewhere go hide and make yu stay der alone.


“ ‘Make una give di burnt ofrin to God as each mont start: two yong melu; one ram; seven man lamb wey bi one year and all of dem must dey okay.


Make una blow ram horn wons new moon or full moon festival start!


So make una nor let anybody take food, drink, party, new moon or Sabat Day matter, take judge una.


Naim di brodas send Paul go di wotaside, but Silas and Timoti still stay for Berea.


Den, dem kon pick stone won stone am, but Jesus hide kon komot from di temple aria.


Wise pipol dey si trobol dey run, but foolish pipol go run enter kon sofa pain.


If to sey na enemy dey laf mi, I for fit bear-am. If to sey na enemies dey make mout for mi, I for fit hide from dem.


For di third day, yu go-go stay for di place where yu first hide put wen all dis tins start. Make yu stay near Ezel Stone.


If yor papa notis sey I nor dey di tabol, make yu tell am sey, ‘I beg yu make I go Betlehem, bikos di time wey di whole family dey sakrifice evry year, don rish.’


But di husband ask, “Wetin make yu wont go si am today? Today nor bi new moon or Sabat Day.” But di woman ansa, “Evritin dey okay.”


Jonatan ansa David, “Tell mi wetin yu wont make I do for yu.”


Jonatan tell David, “Tumoro na new moon and I go miss yu, bikos yor seat go dey empty.


So David kon hide for di field. Wen di new moon kom out, di king kon sidan to chop en food.


But di next morning for di sekond day for di new moon, David seat still dey empty. So Saul kon tell en pikin Jonatan, “Wetin make Jesse pikin neva kom chop for dis tabol? E nor kom yestiday and e nor dey here today.”


Una dey tell unasef sey, “Wen di new moon festival go end sef, so dat wi go fit go sell awa korn? Na wen Sabat go end, make wi for fit sell again? Wi nor fit wait to shit awa customers, use wayo take measure tins, so dat wi go get more money.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka