Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 20:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Jonatan ansa am, “Nor-tin go fit kill yu! My papa nor go fit do anytin escept e tell mi first. Wetin make my papa nor gri tell mi about dis matter? E nor go fit happen!”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 20:2
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

bikos I don tell dem di message wey yu give mi. Dem don asept wetin I tell dem and dem know and bilive sey na yu send mi.


Naw, di day before Saul kom, God don tell Samuel:


Jonatan tell David, “Di Oga wey bi Israel God na my witness. I go tell my papa dis tin for di day afta tumoro. If wetin e tok favor David, I nor go send word kon give yu?


But di sojas sey, “Make Jonatan wey win dis war for Israel, die? E nor go ever happen! As long as God dey alive, one hair for Jonatan head nor go even fall rish groun! Bikos na with God help, e take do wetin e do today.” So di sojas nor let dem kill Jonatan.


“Wi nor go ever disobey God and wi nor go fit turn back from God kon build altar wey wi go dey burn ofrin or do sakrifice put, apart from di altar wey dey awa Oga God Temple!”


Dem ansa di savant, “Wetin make awa oga tok like dis? E nor dey possibol for yor savant to do dat kind tin!


I nor go koll una savant again, bikos savant nor dey undastand wetin en oga dey do, but I dey koll una my friend, bikos I don show una evritin wey I hear from my Papa.


E go kom distroy all dis tenant, den give di grape farm to new tenants.” Wen di pipol hear dis, dem kon sey, “Make dis tin nor happen o-o!”


God don make mi undastand well-well and I neva tok anyhow or turn from am.


Yu really don make mi undastand sey, nor bi only sakrifice and ofrin yu wont. True-true, Yu nor just wont only burnt or sin ofrin.


Di pipol ansa, “Make God ponish us, if wi go woship anoda god!


David run go Naiot for Rama. E go meet Jonatan kon ask am, “Na wetin I do? Na wish bad tin I do? Na how I take sin against yor papa? Bikos e won kill mi!”


But David sey, “Yor papa know how yu like mi well-well and e don gri for en mind sey, ‘Make I nor let Jonatan know about dis matter, bikos if e know, e nor go dey happy!’ But as long as God dey alive, na small tin make mi neva die!”


Pesin wey bi tif patina nor like en life, bikos even doh e know di trut, e don swear sey e nor go tok.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka