Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 2:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 E dey karry weak pipol komot from san-san and dey make poor pipol sidan with prince and princess kon put dem for where pipol go honor dem. Di foundashon wey di eart sidan put, na God get am; na on-top am E build di world.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 2:8
31 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So di king give Daniel high post with many fine gifts. E gi-am pawa for evry aria for en kingdom kon make am leader ova all di wise men for Babilon.


My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?


Naw as e bi, di work wey Daniel dey do, show sey e betta pass oda supavisors and ofisas. So bikos Daniel get betta wisdom, di king kon plan sey, make only Daniel dey in-chage of di whole kingdom.


di one wey give us betta kingdom kon make us priest wey go dey serve God wey bi en Papa, make glory and pawa bi en own forever and ever! Amen.


Even if dem born dat youth for poor house or if e dey prison since, e fit kom out kon bi king for en town.


Samuel sey, “Even doh yu feel sey yu nor dey important, yu still bikom God pipol king. Na God choose yu as king ova en pipol.


Nite nor go dey again and dem nor nid lantan or sun lite, bikos God go bi dia lite and dem go rule forever and ever with am.


Yu don choose dem as kings and priests wey go serve God and dem go rule for di eart.”


So make yu tell David wey bi my savant sey, di Oga God sey, ‘I take yu komot from where yu dey kare for animal kon make yu rule Israel wey bi my pipol.


Bikos I bear rish di end kon follow my Papa sidan for en throne, anybody wey fit bear rish di end, go follow mi sidan for my throne too.


Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.


Yu build di world on-top strong foundashon, so dat nobody go fit remove am.


Na wen di world just start, Yu build di foundashon for di eart kon make di heavens with yor hand.


E build di eart foundashon on-top sea kon make am stand on-top wota.


Den Fero sey make dem go koll Josef kom. So dem take Josef kwik-kwik komot from di prison kon shave en hair and shange en klot, den dem take am go meet Fero.


Job sidan outside near dirty kon use breaki-breaki pot take dey skrape en sore.


Na yu go take kare of my house and all my pipol go obey yor kommand. Na only mi, di king go dey great pass yu.”


Dis na di decision wey di angel make. So, make evribody wey dey di world know sey di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E choose! Even to di pipol wey small pass!’


“Even doh yu nor important, I still make yu lead my pipol, Israel. Naw yu don disobey mi like Jeroboam kon make my pipol sin and dia sins don make mi dey vex.


So Jehu stand up, follow am go inside. Den di profet pour di olive oil for en head kon sey, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok, ‘I don choose yu as Israel king.


Den e sey, “Dem nor born mi with anytin and wen I die, I nor go karry anytin follow body. Na God dey give and E don take. Make wi praiz God name!”


Di eart go shake and evribody go fear, bikos na mi make di foundashon.


bikos na God dey judge! E dey bring one pesin down and karry anoda pesin up.


Yet E save poor pipol from doz wey dey opress dem kon make dia family many like plenty animals.


I go nail am like peg for one strong place and e go bring honor and respet kom en papa family.


I don warn proud pipol sey, ‘Make dem stop to dey make mout!’ kon tell wiked pipol sey, ‘Make una nor dey happy sey una don win!


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka