1 Samuel 2:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
22 Naw, wen Eli don old well-well, e kon dey hear evritin wey en boys dey do to evribody for Israel and how dem dey sleep with wimen for di temple door-mot.
Di priests break my law and dem nor dey respet anytin wey dey holy. Dem nor know wetin dey holy or not. Dem forget di Sabat; dem nor dey tish about wetin dey klean again. So bikos of dis, Israel pipol nor dey gri respet mi again.
Na Jakob story bi dis: Josef wey bi seventeen years dey kare for di sheep with en brodas. Naw e bi small boy wey dey work with en papa wifes, Bilhah and Zilpah sons. Josef kon tell en papa bad tins about dem.