Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 18:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Wen dem kom back afta David don kill Filistia pipol, di wimen for di town kom out kon dey sing, dey dance go meet King Saul. Dem dey happy as dem dey play dia instruments dey kom.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 18:6
11 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen Jeftah rish en house for Mizpa, en only pikin wey e get for en life, run kom out kon meet am, dey dance and play tamborin with happiness.


Den Miriam, Aaron sista wey bi profet kon take en sheke-sheke and all di rest wimen follow am too dey play dia sheke-sheke as dem dey dance.


Pipol wey dey sing, dey waka for en front; while di odas dey play dia instrument dey follow for back and yong girls dey play dia sheke-sheke.


Miriam sey, “Make wi sing to di Oga awa God, bikos E don win big war; E trow di horse and doz wey dey ride am inside di sea.”


Anytin wey Saul send David go do, e dey do am well with sense. So Saul kon make am oga ova di sojas. Dis tin kon make belle sweet di sojas and even Saul savants.


Make yu nor announce am for Gat or for Ashkelon strits. So dat Filistia wimen and di pipol wey dey woship juju, nor go happy.


David and Israel pipol sing and dance well-well to take honor God. Dem dey play harp, jita, drums, sheke-sheke and cymbals.


God tok di word; many wimen spread di good news sey:


Make una dance praiz en name with sheke-sheke and jita,


Evry blow wey E give dem, Israel pipol go support am with music from dia trumpet and jita and E go attack dem with en swod.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka