Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 13:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 So Saul sey, “Make una karry di burn ofrin and di peace ofrin kom.” Den e kon do burnt ofrin.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 13:9
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

One day, Solomon go do sakrifice for Gibeon, bikos di altar wey dey der, fine well-well. E don rish 1,000 times wen Solomon don burn ofrin give God for der.


For der, una go karry burnt ofrin, sakrifice, vow ofrin, ordinary ofrin and una ofrin for di first fruit and animals wey una get.


Wiked pipol dey do tins for God like sey dem dey do am give juju and dis kind tin dey make God vex for dem. Weda dem kill melu as sakrifice, dem go dey guilty like sey dem kill human being. Even if dem sakrifice lamb, e go bi like sey na dog dem sakrifice; even if na rice dem present, dem go dey guilty like sey dem offa pig blood as ofrin; or if dem offa incense give God, dem go still dey guilty like who offa am give juju, bikos dis pipol don choose dia own way and dem like di yeye tins wey dem dey do.


God nor like wen wiked pipol dey offa sakrifice gi-am, bikos dem dey do am with bad belle.


Instead of sakrifice, make pesin do wetin good and korrect; tins wey go make belle sweet God.


Nor do bad to pesin wey do yu bad, but make yu trust God and E go save yu.


God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.


So, make yu wait for God with patient! Make yu get mind as yu dey wait am! Make yu nor worry about wiked pipol wey dey prosper or fear, bikos of wetin dem get.


Den e build altar for der kon give God burnt and fellowship ofrin. So God ansa en prayer and di sickness for Israel kon stop.


So Saul tell Profet Ahijah, “Go bring di efod kom here.” (Bikos for dat day, Ahijah karry am for di sojas front.)


but una must woship di Oga una God for where en ensef go choose from among all di tribes and na der una go for honor en name.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka