Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




1 Samuel 1:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Di next day, Elkanah and en family wake-up for early morning go woship God, den dem kon go back to dia house for Rama. Elkanah sleep with en wife Hannah and God kon remember am.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




1 Samuel 1:19
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God kon visit Sarah just as E sey E go do and E kon do wetin E promise Sarah.


So e kon promise God sey, “My papa, if Yu go sorry and remember mi, yor savant, den give mi one boy pikin, I go dedikate am give Yu as long as e dey for dis life and dem nor go ever kut en hair.”


Den God sorry for Rashel. E hear en prayer kon make am get belle.


Adam sleep with Eve en wife and e get belle kon born boy, den e sey, “I don get boy just as di Oga God wont!” So e koll am, “Kain.”


Den e tell Jesus, “Wen yu rish yor kingdom, make yu remember mi!”


For early morning wen evriwhere still dark, Jesus leave di house go one kwayet place go pray.


I dey wake-up before day break well and yor words dey give mi hope.


For morning, aftanoon and nite, I dey kry with pain and God hear my vois.


Make Yu nor remember di sins wey I kommit wen I yong. Remember mi for di lite wey yor love wey nor dey fail dey bring, bikos Yu my God, dey sorry for pesin.


As dem wake-up for morning, Samuel koll Saul on-top di house kon sey, “Make yu get up dey go house.” So Saul get up and di two of dem kon go outside.


But God remember Noah and all di animals wey dey inside di boat. So E make one breeze blow for di eart, den di wota kon dey dry small-small.


Di Pesin wey dey remember and fight for us wen wi dey trobol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever,


Make Yu listin to my vois for morning, bikos evry morning, I dey kom meet Yu and dey wait with patient make Yu ansa mi.


Den, Elkanah and en family kon go back to Rama. But Samuel stay for Shiloh dey serve God with Eli wey bi di priest.


E get one man wey kom from Ramataim Zofim for Efraim kountry wey dey on-top hill and en name na Elkanah. Elkanah papa name na Jeroham. Elihu wey bi Tohu pikin, na-im born Jeroham and na Zuf wey kom from Efraim tribe, bi Tohu papa.


Den e go kom back to Rama, bikos en house dey der. E still dey judge Israel pipol for der and e build one altar for der wey dem for dey woship God.


So all di leaders for Israel gada go meet Samuel for Rama


Samuel kon go Rama, while Saul go en house for Gibeah.


So Samuel take di horn wey olive oil full kon anoint di boy for en brodas front. God Spirit kon enter David body from dat day go. Den Samuel kon go Rama.


Naw, David don run go hide. E run go meet Samuel for Rama kon tell am evritin wey Saul do am. Den en and Samuel kon go stay Naiot.


Samuel die and evribody for Israel gada kon mourn for am. Dem beri am for en house for Rama. Den David kon go Paran desert.


Just as Elisha don promise am, di woman get belle kon born for di time wey Elisha tok.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka